Hello Bae!!!



Hello bae,
So you bin dey call yourself SLAY MAMA but e don TEY wey u PRAY last...

Chai, bae I go like beg you make you PRAY before the devil target
you and turn you to a PREY con serve you on a TRAY so tey him guys go
dey chop you like pizza..

Bae, are you feeling me???
OK, thank you..

Come to think of it..
SLAY MAMA wey no sabi PRAY.. Does that one know wetin e mean to SLAY???

Bae, abeg no just put BRAIDING on your head, try get FIRE OF THE HOLY GHOST in your spirit.

Lastly, make I add Jara on top...

# Be informed that the true value of bae is not in her ability to use snapchat on social network, her true value lies in her ability to put smile on people's face (through the virtues wey she get) both
online and offline.

Bae, abeg GO GET SOME VALUE

Ojo Michael (2019)

Post a Comment

2 Comments